BBC News, Pidgin - Home
Top Tori
Political parties neva release list of successful candidates from dia primaries five days after
Afta political parties conclude primaries pipo bin dey expect official list but till now apart from di presidential candidates wey dem announce odas neva dey sure.
Nearly 50 pipo die of thirst for Sahara desert afta lorry break down
Only two pipo survive afta dem trek for more dan 50km (30 miles) across di desert to alert di authorities.
Fake security alerts and wetin police say go happun to pipo wey dey behind dem
Nigeria police don warn against di spread of fake news and false security alerts wey don dey on di rise across states of di federation.
How Nigerians fit sell electricity to national grid - who dey qualify?
Dis one dey come as di power situation for Nigeria don cause kwanta sotey di kontri presidential building, Aso Rock don invest in solar power even wit regular reports say di grid dey collapse.
Oyo Assembly Speaker reject negotiation wit bandits over kidnap of schoolchildren and teachers
Over di years plenti mass kidnapping of schoolchildren, students especially girls schools full for news but e neva dey clear how govment dey take rescue dem.
Why Nigeria still dey struggle wit insecurity despite high security spending
Despite years of military operations, rising defence budgets, and repeated goment interventions, insecurity remain one of Nigeria most pressing challenges.
UK introduce harder rules wey fit ban sponsorship for international students
Dis move na part of effort to stop visa abuse, according to authorities.
FBI shoot and kpai man wey hold pipo hostage inside California bank
Tori comot on Tuesday, 2 June say one man hold plenti pipo hostage inside Chase Bank building wey dey for Chester Avenue and 17th Street, say di hostage taker carry bomb.
Key events wey don happun since kidnap of schoolchildren for Oyo and Borno states
Di kidnap of plenty pupils and teachers from schools for Oriire Local Government Area of Oyo State south-west Nigeria and for three schools for Borno state north-east Nigeria on 15 May, don spark widespread outrage across di kontri.
Special Tori
Sixteen stadiums for USA, Canada and Mexico wia dem go play 2026 Fifa World Cup
Di 2026 Fifa World Cup go kick off on Thursday, 11 June. To stage dis veri big event, Fifa don select 16 host cities across North America, wey show some of di world most beautiful and iconic stadiums
Presidency announce arrest of suspect wey allegedly dey behind Tinubu AI-generated audio
Bayo Onanuga wey be di Special Adviser to di President on Information and Strategy on Thursday, 4 June say di Inspector General of Police crack team gbab one Ifechukwu Dennis wey allegedly dey behind di audio.
Building collapse kill one pesin, fire burn Makola market and police barracks during heavy rain same night for Ghana
Di Ghana National Fire and Rescue Service (GNFRS) confam say di pesin wey die na female, wey dem carry di bodi put for bodi bag wey di police carry am comot di scene.
Shell don dey pump oil for Nigeria pipeline for years despite pollution evidence - Documents show
Di oil giant tok say di documents ignore di critical context of di complex operating environment wen e happun.
Sokoto hospital wia women dey give birth ontop mats
Badawa Primary Healthcare Centre, wey residents say na important facility for di community, don dey neglected afta one strong windstorm damage parts of di building almost ten years ago.
Nigerian teachers protest abduction of schoolchildren and teachers as victims still dey captivity for ova two weeks
Residents, labour activists and civil society organisations for di three states enta di streets to demand for di release of di victims and also dey ask diauthorities to strengthen efforts to address di worsening security situation for Nigeria.
Two pipo die for di Kenya protests against US Ebola quarantine centre plan
Di US plan don make di public dey vex and e don lead to demonstrations near di site of di proposed treatment facility.
BBC News Pidgin now dey on Whatsapp
No dull yoursef, be di first to get latest tori, analysis, exclusive interviews and ogbonge coverage of Nigerian and International news from BBC News Pidgin, straight to your Whatsapp.
